Read Story: SEASON 1 EPISODE 7
.
(continuation from the last scene)
Ambrose side of the story
.
As i heard the scream from the sitting room
i hurriedly stood up from my bed and went
straight to the sitting room, i piped and saw
my Father discussing with my cousin, and
from how my cousin face look, i knew my
dad was telling him about what happened
yesterday night, i walked back to my room
took my bath brushed my teeth and went
back to the sitting room and met only my
cousin smiling like someone who just
caught a new babe, i sat down quietly
avoiding his eyes contact.
Cousin: guy man you don use style slap your
papa nah
Me: na lie o na mosquito o
Cousin: guy forget about the mosquito of a
thing na me and you dey here now, abeg tell
me wetin happen joor
Me: na last night wey i went inside my dad
room to carry im laptop, i carry am finish o i
no know the devil wey send me to check
whether im the sleep sound, na im i come
notice one mosquito wey dey busy the s--k
blood like vampire as i won kill am im come
fly na im i come slap my papa immediately
NEPA come bring light, as i no provide
evidence nah, na im my papa use me do
frying pan,
Cousin: oga o you sabi lie o, abeg i the
throwey cap for your lie e too much
Me: you say me the lie?
Cousin: yes nah na lie i no believe you
Me: see this yeye guy i tell you make you
believe me?
Cousin: why you come the tell me nah
Me: no be you ask me? Abeg leave me joor
as we were busy dragging on the issue na
im our long lost friend Gentle just come
inside my house, (hope you guys remember
Gentle the one that made his babe parents
to remove the roof of their house promising
them to renovate it and since then has
disappeared, yes i now know you remember
him) he just walked in, me and my cousin
were speechless
Gentle: my people this one una open mouth
like that the look me wetin happen
Cousin: Oga Gentle i the throwey cap for you
o
Me: even me the throwey my boxers for you
o
Gentle: why una the throwey una things
Cousin: shey na you wey make your inlaw to
comot the roof of their family house
promising them to renovate the house for
them
Me: guy you wicked o
Gentle: guy make una forget that thing,
them been do there own through
wickedness so me come show them part 2
of wickedness
Cousin: oga you try for that one
Me: a round of applause for the deputy
chairman planning committee
Gentle: who come be the Chairman
Me: na my yeye cousin o
Cousin: your father left yansh
Me: your papa labs
Gentle: guys enough o, i got gist for una
Cousin: the yan us
Gentle: e get this girl for…..(i cut in)
Me: so na girl make you dey serious like
this?
Cousin: no mind am see im belle na so so
woman e the pursue
Gentle: you guys no say me don change
finish nah, remember that time i the pursue
old women nah, Ambrose like your Grand
mother nah
Me: na your Great Grand Mother you pursue
ijiot
Gentle: fool
Me: He goat
Gentle: fowl.
Me; your stupidity get plate number
Gentle: your mumu life dey registered
Cousin: guys e don do, so Gentle Who be the
girl
Gentle: her name is Nkechi wey the sell food
for market
Me: wait, you mean say she the sell food?
Cousin: na that one you go hear well
Gentle: yes nah she the sell food abeg i won
make we package am
Cousin: Oya make we the go nah
Me: but guys i get babe o
Gentle: na you wan get her no be me?
Me: ok o make we the roll
———————————————–
Nkechi side of the story
i was still busy serving the customers when i
sighted 3 guys approaching my shop with a
smiling face, i need no body to tell me their
aim, but wait o i like the 3 guy, well let me
serve them first
Me: my customers wetin i go bring for una?
1 guy: my name is Gentle, this is Ambrose
and Samuel
Me: ok, what will i offer you guys?
Gentle: i want rice
Samuel: i want Rice
Ambrose: see this guys come the claim
oyinbo, abeg you get Akpu?
Me: yes i have that
Ambrose: thanks you, abeg load am well
well make i no how sweet you can cook
Me: ok
i left them to go and carry out their request,
d--n that Ambrose is Handsome, and very
jovia, if i was a guy and his a girl i would
approach him, well let me give him my best
food… As i was busy preparing their order i
looked outside and saw that Gentle guy
smiling at me hmmm…..
————————————
Ambrose Side of the story
Me: guys that girl fine o
Gentle: yes she’s beautiful
Cousin: Yes she is, now what is the next
move Mr Gentle
Gentle: why you come the put the Mr
Me: because you get inlaw nah
Gentle: na you wey get inlaw abeg make i
approach am
Me: guy come drink water first
Cousin: leave am make im the go
Gentle looked at us and smiled while
approaching Nkechi
Me: but Guy will that Nkechi accept am
Cousin: me no know o, make she do o
Me: yes o make we the chop free food
Cousin: bia Ambrose you and food be
brothers
Me: that once concern you o
.
{{comment.anon_name ?? comment.full_name}}
{{timeAgo(comment.date_added)}}
{{comment.body}}
{{subComment.anon_name ?? subComment.full_name}}
{{timeAgo(subComment.date_added)}}
{{subComment.body}}